Pages

JOKE:- A CONVERSATION BTW AIDS & EBOLA

AIDS: Bros na wah for you oo, you just come everybody they fear you like death, where you get ur own from.

EBOLA: Ha ha ha, I been tell u that time naa, say make you wait ,make you neva commot, you no gree, u rush come out, e no tey doctors tidy you... but see me now, the patient dog, eats the fattest bone.

AIDS: na wahoo, everybody dey fear oo, no body dey nea rperson wey you catch oo, but me, if i catch someone, no one go send, people go dey even chop wit am, hug am, even 'sleep' with am sef, without issue.


EBOLA: Bros i ready come, u know native doctor wey do dis juju for me? I dey pursue somebody sef even if him don die...u no fit carry person wey I kill from state to state like that oo.
AIDS: Even hospital sef dey fear you oo, if dem carry your victim come hospital, d hospital don close be that, bt me,everybody go dey go normally like say i no dey there sef.

EBOLA: Bros, no be me do u oooooo, na only you waka come naaa.
AIDS: Your case tire me ooo, I wan be like you oo, you just make me look like nothing now. Even me dey fear you cos you fit catch me sef........but know sey, all these Virus you are sharing, remember that 'diaris God oooooo:

No comments:

Post a Comment

Hi! Thanks for visiting my blog. Please dont forget to invite your friends and To say something